DR Congo protest: Wetin dey happun wey make citizens dey protest against USA, France for DR Congo
9 February 2024
Serious protest don dey happun for di Democratic Republic of Congo protest against foreign kontris wey dem allege say e dey control dia mineral resources.
Di protester bin block di UK embassy for Kinshasa. Dem dey accuse say US, France and UK bin dey back Rwanda for di war crimes wey dem don commit.
For di video wey spread for social media, di protesters bin block di entrance of UK embassy wit tyres as dem dem burn fire for di road.
[Read More]